Tuesday, November 17, 2009

I don tire

Book don tire me. My eyes dey red, brain dey pain me, back dey pain me, the devo boring put on top. Still i dey there, i go dey there until i finish. If i no finish, i no go leave am. I no fit sleep again o, after i sleep yesterday like pesin wey get sleeping sickness. We just finish block 3 exam on Friday, u go think say person go fit rest, for where?!! The madness don start again O!. No be pesin tell me make i carry myself go Target go buy energy drink. Na so i see am o! Devo dey use my eye see pepper meanwhile class average for last exam na 87. Hmmm..... na me and u this blk 4 devo, i go pass u o. Na by force, u no get choice. I must be doctor, that one na by force too!

Oya o, my break don finish. I don go.

If u can't read pidgin english, pele. I did not feel like writing in english. This one don pass english matter. I had to go back to my roots.

6 comments:

  1. eyah.. pele... God pass dem!

    P.S.>> Pidgin theraqpy works.. try it again..

    ReplyDelete
  2. That was a hard read for me! But i get you! sometimes it just help! Hand in there babe1

    ReplyDelete
  3. In the end, you'll be smiling for sure.

    ReplyDelete
  4. Say werrin?
    Class average na 87?
    My dear, na u go lead the pack.
    AMEN!

    Hang on.

    ReplyDelete
  5. pele dia! dem go run down! LOL

    It is well...

    ReplyDelete

Hey guys, welcome to my blog. Sit back, relax, grab a cup of coffee and enjoy!

  © Blogger template Writer's Blog by Ourblogtemplates.com 2008

Back to TOP